Limpopo Pig farm murders: Latest as South Africans vex afta dem find bodies of women wey farmer allegedly kill

Maria Makgato

Wia dis foto come from, Makgato family

Wetin we call dis foto, Maria Makgato, a single mother of four sons follow for one of di late womenArticle informationAuthor, Nomsa MasekoRole, BBC News, Polokwane

2 October 2024

Maria Makgato and Lucia Ndlovu, bin dey look for food for one farm near Polokwane for di northern province of Limpopo for South Africa in August, wen di owner of di farm, Zachariah Johannes Olivier, allegedly shoot dem die.

E come carry dia dead body give im pigs to chop in attempt to cover di evidence according to di accuse.

Di matter don cause plenty anger for di kontri wey still neva fully recover from di experience of apartheid wey happen for many years.

Court go now decide weda to grant bail to di 60-year-old white farmer and im two employees, 19-year-old Adrian de Wet and 50-year-old William Musora, ahead of dia murder trial.

Di three men neva enter dia plea for court. Dat one go happen wen dia trial go start proper.

During di previous hearings, protesters bin gada outside court to demand make di suspects remain for custody.

Walter Mathole, di brother of Maria Makgato tell di BBC say di incident don worsen di racial tension between black and white pipo for South Africa even though e don pass 30 years since di end of di racist system of apartheid.

Di three men for court dey also face charges of attempted murder for shooting at Mabutho Ncube, di husband of Lucia Ndlovu – one of di women wey die.

Mr Ncube bin dey wit di women wen di shooting happen on August 17, but e manage to crawl away after bullet hit am, and e later call a doctor for help.

Na im also report di matter to di police who say dem find di decomposing bodies of im wife and Maria Makgato for di oga Olivier pig farm some days later.

Mathole tell BBC say e follow di officers inside di pig farm wia e see as pigs don partly chop im sister bodi.

Tori be say dem bin go to dat farm to look for food wey don expire or wey don dey near to expire. Food like dat na wetin pigs dey normally chop.

Di family of Makgato tok say dem dey devastated by her death, especially her four sons wey di oldest na 22 years and youngest na just five years old.

“My mama die painful death. She be loving mother and she do everything for us. We no lack anytin bicos of her,” her oldest son Ranti Makgato tell BBC.

“I go sleep beta for night if her alleged killers no get bail,” e tok.

Di opposition Economic Freedom Fighters (EFF) party want make goment shut down di farm.

“Di EFF no fit stand by dey watch as products from dis farm continue to dey sell for market bicos dem dey dangerous to consumers,” di party tok afta police find di dead bodies.

Also, di South African Human Rights Commission don condemn di killings and call for anti-racism dialogues between di affected communities.

Groups wey dey represent farmers, who be usually white, tok say di farming communities dey always feel under attack for a country wey get high rate of crime.

But e no get any evidence to show say farmers dey face greater risk pass anyone else.

Recently, two similar incidents don happen wey high di racial tensions for South Africa.

For August, for di eastern province of Mpumalanga, one farmer and im security guard allegedly kill two men for one farm for Laersdrift, close to one small town, Middleburg.

Di men bin dey accused of stealing sheep, and di farmer and im guard burn dia deadi bodi beyond recognition.

Police don arrest dem and dem remain for custody while investigators dey do DNA analysis on di ashes of di dead men.

Di most recent case na di one wey one 70-year old white farmer – Christoffel Stoman, from Lutzville for Western Cape province – bin allegedly drive over one six-year-old boy and break im two legs for stealing orange from im farm.

Tori be say di boy and im mama bin dey pass di farm as dem dey go buy sometin for town wen e pick up orange for di ground. And in mama dey dia dey watch in horror as di farmer climb di boy wit im car.

Di National Prosecuting Authority (NPA) say di farmer dey face two charges of attempted murder and reckless driving.

NPA tok-tok pesin Eric Ntabazalila tell BBC say di state dey oppose di bail application wey di accused pesin bin file.

Two political parties – di African Transformation Movement and di Pan Africanist Congress – wan goment to seize Mr Stoman farm sake of di matter.

Source link : https://www.bbc.com/pidgin/articles/c80rg8k4ekvo

Author :

Publish date : 2024-10-02 11:27:11

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version