South Africa vs Nigeria highlights: Super Falcons qualify for Paris Olympics afta goalless draw wit South Africa

South Africa vs Nigeria highlights: Super Falcons qualify for Paris Olympics afta goalless draw wit South Africa

Wia dis foto come from, NFF

Wetin we call dis foto, Nigeria Super Falcons win di first leg 1-0

9 April 2024

Nigeria don qualify for di women football event of di 2024 Olympics.

Nigeria Super Falcons qualify afta dem play goalless draw against South Africa for Pretoria.

Nigeria dominate di first half but hosts South Africa change tactics as dem begin attack and mount pressure on di nine-time African Champions.

Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie performance help secure dis important win for di Super Falcons.

Dis na di first time Nigeria Super Falcons dey qualify for Olympics afta 16 years.

Di last time dem qualify na 2008.

Match highlights

Second Half

Full Time South Africa 0-0 Nigeria

90+2 South Africa and Nigeria dey play short short passes wey dem dey intercept

90′ Referee add 3 minutes

90’South Africa don get plenti opportunities to score but dem no fit score till now.

88′ Nigeria move close to South Africa goal area but South Africa clear di threat.

86′Save! Chiamaka Nnadozie save beta ball from South Africa, di ball dey move towards Nigeria goalpost but Chiamaka jump catch di ball.

83′ Substitution for Nigeria Asisat Oshola don enta for Chinwendu Ihezuo. South Africa don make changes too.

81′ Nigerai string like five passes for di South Africa goal area , di last shot land for South Africa goalkeeper Swart hand but e leave her wit small injury afta Referee blow whistle.

80′ South Africa don up dia game for dis second half, dem dey dominate di midfield and also dey press Nigeria defence.

78′ Christy Ucheibe of Nigeria clear di ball from South Africa wey wan enta post sharp sharp as she pass am to Deborah Abiodun.76′ Injury for Nigeria as Ihezuo dey receive treatment. Match don continue and South Africa dey Nigeria goal area but Alozie clear di ball.

72′ Freekick to South Africa afta Ayinde foul Sout African player but Nnadozie catch di ball wey Seoponsenwe of South Africa play.

71′ Freekick for Nigeria Rasheedat Ajibade play am but e land for Swart hand.

70′ Save! Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie don recover, she immediately save one goal bound ball from South Africa

68′ Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie dey receive treatment afta Thembi Kgatala of South Africa collide wit her as Chiamaka comot from goal post to catch ball outside.

65′ Kgatlana dey get good balls from dia midfielders. She make beta run into di goal area but Mitchelle Alozie of Nigeria clear di threat.

64′ Nigeria no dey dominate di midfield again as most of di players don fall back to defend. South Africa dey control di game now.

61′ South Africa dey press Nigeria now wit plenti crosses near Nigeria goal post but Chiamaka just dey catch evri ball wey dey come close.

60’South Africa make beta run into Nigeri goal area but Nigeria defender clear di ball.

58′ Nigeria take control of di midfield as dem connect five passes successfully but South Africa defender clear di final pass near dia goal area.

56′ Nigeria player Toni get injury, dem dey treat her for sideline, match don resume sharp sharp as Referee say time no dey to waste.

54′ South Africa bin get freekick near Nigeri goal area but Alozie no give dem space to play di ball as she block am.

53′ Toni Payne of Nigeria no dey give South Africans space at all, both Nigeria and South Africa don dey play di ball fast fast now.

50′ Substituiton for South Africa Cesane don comot and Hildah Maigaia don enta.

49′ South Africa start dis second half wit plenti action, dem just dey fire shot for Nigeria goal area anyhow but Nigeia goalkeeper Chiamaka Nnadozie dey gidigba for goal post.

48′ Thembi Kgatlana of South Africa get chance to score , she beat two Nigeria defenders but she fire her shot wide!

47′ Yellow card! Nigeria don collect di first Yellow card for dis match as Referee give Toni Payne card for foul.

46′ Substitution Nigeria don change Uchenna Kanu wey get injury Babajide don replace her.

46′ Seconf half don start.

First Half

Half-Time Nigeria 0-0 South Africa

45+2 Thru pass for Rasheedat Ajibade but di ball run pass her and South Africa goalkeeper pick di ball.

45′ Referee add 2 minutes

45′ Nigeria player Uchenna Kanu dey for ground e be like say she don get injury few second to wen first half go end.

43′ Osinachi Ohale of Nigeria tackle Kgatloe of South Africa Referee warn her.

42′ South Africa make beta run towards Nigeria goal area but di shot land for di safe hands of Chiamaka Nnadozie.

40′ Nigeria give South Africa goal scare afta dem pass ball for Uchenna Kanu for di left side of di post but Kanu no prepare for di ball, e just land for South Africa goalkeeper hand.

37′ Nigeria players especially di defenders no dey give South Africa space at all to play dia game. Any small pass South Africa make Nigeria go tiff di ball or tackle dem.

36′ Christy Ucheibe of Nigeria clear ball wey dey go near Nigeria are afta South African player Seponsenwe pass di ball.

34′ Freekick for Nigeria, Osinachi Ohale play am but e land for di hands of South Africa goalkeeper Swart.

30′ Thembi Kgatlana dey complain afta Nigeria defender Mitchelle Alozie bring her down as she bin dey make one beta run near Nigeria goal area.

29′ South Africa and Nigeria just dey tackle diasefs for any small pass, no free flowing play for di last two minutes.

26′ Seoponsenwe of South Africa push Nigeria player down, Referee blow foul against South Africa, Nigeria play di very long freekick but South Africa defenders head di ball out.

25′ Osinachi Ohale of Nigeria make good run from di midfield but South African player tiff di ball from her leg to stop di goal bound move.

24′ Corner kick for Nigeria, Rasheedat Ajibade take di kick but South African defenders block di ball.

22′ Nigeria dey hold possession of di ball, Echegini dey dribble players and finally pass di ball to Kanu wey play shot but e go wide.

19′ Save! Nigeria Goalkeeper Chiamaka Nnadozie save beta shot from South Africa , but Assistant Referee raise flag for offside.

17′ Beta action neva too dey but Nigeria dey dominate di match so far as Deborah Abiodun of Nigeria no dey let di South African player see beta space to play ball.

14′ Deborah Abiodun of Nigeria clash wit South African player KGaole wey result to injury , Referee pause di game small to treat her but evritin dey alright now, match don continue.

12′ South Africa dey play short short passes for di midfield to try draw Nigeria out but di Super Falcons dey try attack dem.

10′ South Africa get corner kick , but dem play am wide.

9′ Nigeria take possession of di ball from midfield as dem snatch di ball from South Africa leg but nothing come out.

7′ South Africa and Nigeria still dey try settle down for di match.

Di reigning women African champions, South Africa go play Nigeria on Tuesday evening for di second leg of di CAF Women Olympic qualifier match.

Nigeria Super Falcons win di first leg 1-0 for Moshood Abiola stadium for Abuja on Friday 5 April.

Super Falcons captain Rasheedat Ajibade score di only goal for di match from penalty kick afta South African player Noko Matlou foul Chiwendu Ihezuo inside di box.

Na Ajibade score Nigeria last two goals against Banyana Banyana.

She score di consolation goal for Super Falcons 2-1 defeat wen dem bin face each oda for Rabat on 4 July 2022.

Di gap between dis two teams no big like im bin dey for 1990s wen di Super Falcons bin flog Banyana Banyana 7-1 in front of dia own fans for Johannesburg for 1995 FIFA Women’s World Cup qualifying match.

Tori be say Banyana Banyana still neva win Super Falcons for any match wey dem don play for South Africa.

Dis two team don play each oda 24 times (seven for inside South Africa), Nigeria don win 15, five end for draw and South Africa don win four times.

South Africa four wins na for Bata, Equatorial Guinea (1-0, 2012 Women AFCON); Cape Coast, Ghana (1-0, 2018 Women AFCON); Lagos, Nigeria (4-2, Aisha Buhari Cup) and; Rabat, Morocco (2-1, 2022 Women AFCON).

Meanwhile Nigeria seven previous matches inside South Africa see Falcons win five and draw two.

Di two draws happun on 12th March 2004 (Athens Olympics qualifier wey end for 2-2) and a friendly match on 3rd June 2012 wey end for 1-1.

Nigeria neva take part for di Women Olympic Football tournament since 2008.

Di winner of dis tie go pick di women Olympic football tournament ticket wey go hold for Paris.

Dis na evritin you need to know about dis ogbonge women match.

Wia dis foto come from, NFF

Line Ups

South Africa Starting 11: Swart, Dlamini, Gamede, Makhubela Ramalepe. Cesane, Motlhalo, Jane Kgaole, Kgatlana, Seoposenwe

Nigeris starting 11: Nnadozie, Ohale, Okeke, Alozie, yinde, Ucheibe, Echegini, Ihezuo, Kanu

Dey refresh dis page for updates

Source link : https://www.bbc.com/pidgin/articles/cqln2qdendno.amp

Author :

Publish date : 2024-04-09 07:00:00

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version