Protest in Nigeria – Wetin we know as talks to hit di streets spread for di kontri

Protest in Nigeria - Wetin we know as talks to hit di streets spread for di kontri

37 minutes wey don pass

Nigeria presidency don ask kontri pipo to hold on for one planned protest across di kontri.

Di Minister of Information Mohammed Idris wey speak on behalf of President Bola Tinubu as e dey follow State House tori pipo tok for Abuja, di kontri capital, tok say di president dey beg Nigerians, especially young pipo sake make dem no do any protest and give goment more time to actualise government plans.

E add say di ginger for protest na di work of “bad” pipo “wey dey capitalise” on di kontri economic problems.

“On di issue of di planned protest, Mr president no see any need for dat. E ask dem to cancel di plan. E say make dem wait for goment response to all dia pleas,” di minister tok.

Meanwhile, reports dey say di Nigerian goment don schedule one emergency meeting for Wednesday 24 July, to address di mata of di planned nationwide protest.

Why Nigerians dey protest?

Di protest against economic hardship, don dey trend for social media continuously for some weeks now.

Pipo dey complain say dem no fit afford to buy some food and basic commodities sake of say di price don go high.

Nigeria dey battle one of di kontri worst inflation and economic crisis wey goment policies on petrol subsidy removal and unification of forex windows join cause.

Figures released by di National Bureau of Statistics on Tuesday show say di prices of staple foods for Nigeria like rice, beans, tomatoes, potato and yam rise by more dan 250% between May 2023 and June 2024. Garri, Rice.

Even though President Bola Tinubu don approve a new minimum wage of N70,000 from di N30,000 wey be di current minimum wage, some pipo believe say e no reach.

When be di protest?

Reports say e go hold across all states of di Federation plus di Federal Capital Territory (FCT), Abuja, for 1 August.

Meanwhile some state governments and associations don dey caution dia pipo say make dem no follow for di protest.

Source link : https://www.bbc.com/pidgin/articles/cv2gzx97yy7o.amp

Author :

Publish date : 2024-07-24 09:23:48

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version