Nigeria vs South Africa: Super Eagles, Bafana Bafana set to light up Uyo for 2026 World Cup qualifiers game

Nigeria vs South Africa: Super Eagles, Bafana Bafana set to light up Uyo for 2026 World Cup qualifiers game

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria bin dump South Africa out of Afcon 2024 afta a penalty shootout

48 minutes wey don pass

Di Super Eagles of Nigeria go welcome dia perennial rivals – di Bafana Bafana of South Africa – on Friday for Uyo, di capital city of Akwa Ibom State, in di kontri South-South region.

If dem win, Nigeria fit top Group C of di World Cup qualifying series wia dem currently dey on fourth position wit only two points from two matches, afta dem play draws against Lesotho and Zimbabwe in November 2023.

Di last time Nigeria and South Africa meet na for di semi final of di 2024 Afcon wia goalkeeper Stanley Nwabali become di hero as e stop two penalties to take di Eagles through.

South Africa on dia side go also dey plan to revenge dat bitter loss and also to add to di three points wey dem currently get for di group C; dia last two qualifyers end for one win and one loss against Benin Republic and Rwand respectively.

Match time and how to watch

Kickoff time na 8pm Nigeria time (8:00BTS) and Uyo fans wey wan watch di ball live for di Godswill Akpabio Stadium gatz pay N1000 for regular ticket or N3000 for VIP ticket.

Di match go also air live on TV. E neva clear weda di NFF go stream am live for dia official YouTube channel as dem don do for some matches.

Group C standings

Rwanda and Benin Republic don play three matches while South Africa, Nigeria, Lesotho and Zimbabwe don play two games.

Squad

Napoli striker Victor Osimhen na di only major absence for dis Super Eagle side sake of injury.

Also, Nathan Tella wey bin get good season wit Bayer Leverkusen, bin excuse imsef sake of “personal family reasons”.

Oda pipo wey no get call up na captain Ahmed Musa, who many dey think say age fit don dey catch up on am, and centre back Kenneth Omeruo.

In form strikers, Victor Boniface and Ademola Lookman dey expected to lead di Eagles attack dis evening.

Nwabali dey expected to maintain di number one position ahead of Kingsley Uzoho and Maduka Okoye who come bak to di team afta e give a good account of imsef wit Udineze of Italy dis season.

For di Bafana Bafana, goalkeeper Ronwen Williams bin get injury scare but e follow di team travel for dis tie.

Di Mamelodi Sundowns shotstopper bin save four out of di five penalties e face during Afcon 2024 to emerge best keeper of di tournament.

Also, one of dia experienced defenders, Grant Kekana no go play as e comot from di team camp after e get hamstring injury.

Coach Broos invite Given Msimango of Kaizer Chiefs to replace am.

Head to head

Overall, Nigeria get small edge against Bafana Bafana wit six wins, five draws, and just one lose for di 12 times dem don meet.

But dem dey G-G for di last six matches, winning one apiece and playing draw four times.

Source link : https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp33570x704o.amp

Author :

Publish date : 2024-06-07 10:15:03

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version